DebiEye

...giving news a meaning

  • Entertainment
  • Gossip
  • News
  • Family
  • Marriage
  • Debby’s Corner

Follow Us

  • Facebook
  • Instagram
  • LinkedIn
  • Pinterest
  • Twitter
  • YouTube

RCCG members kidnapped in Kaduna: Kidnapping of Redeemed Christian Church of God bus passengers – Police, eyewitness account – BBC News

March 28, 2021 By Leave a Comment

59 minutes wey don pass

"RCCG members kidnapped in Kaduna"

Wia dis foto come from, Eje Friday Faraday

Wetin we call dis foto,

Pishure of di empty RCCG bus afta di kidnapping

Kidnapping of Redeemed Christian Church of God [RCCG] members in Kaduna don dey confirmed by police and BBC Pidgin don get eyewitness account of wetin really happun.

One eyewitness Eje Kennedy Faraday say kidnappers pack all di pipo wey bin dey inside RCCG bus dey go Kafanchan town on Friday evening.

Eje later snap pishure of di empty RCCG vehicle wey bin dey transport di pipo and e still dey unclear wia dem pack di pipo go.

“Kidnappers just pack everybody from RCCG bus along Kachia road, kilometre 63 from Kaduna city.” Dis na wetin BBC Pidgin find out from Eje

Kaduna Police Command tok tok pesin ASP Mohammed Jagile wey confam di kidnapping tell BBC say dem dey compile all di details and will get back with more information.

Dis no be di first time wey di kidnappers go gbab worshippers wey dey on a holy mission for Kaduna state, north west Nigeria.

Dem bin kidnap apostle Emmanuel Bako and im wife Cindy for December of last year as dem dey Albarka praying camp on di outskirts of di city.

Kaduna based activist Senator Shehu Sani on top twitter post say dia state don fully become ‘kidnappers hub’.

“Di report of di kidnapping of RCCG members along Kachia road for Kaduna na yet anoda tragedy.”

“Bandits don turn our state into dia hub and before one kidnapping is resolved anoda one don happun, human beings don become hunted.” Dis na wetin di former senator post.

Share this:

  • Tweet
  • WhatsApp
  • Print

Related

Filed Under: News

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

Debby On Radio

https://debieye.com/wp-content/uploads/2019/02/SINACH-WAY-MAKER_n4XWfwLHeLM.mp3

Quote of the day

Never bend your head. Always hold it high. Look the world straight in the eye.
Helen Keller

Facebook Page

Follow me on Twitter

My Tweets

Need to talk to me?

    Recent Posts

    Chelsea and Manchester City will be clashing heads in the FA Cup on … [Read More...]

    Adriano, a 46-year-old patient suspected of having COVID-19, is … [Read More...]

    By Chibuzo Ukaibe, Abuja The opposition Peoples Democratic Party … [Read More...]

    According to The Athletic, Chelsea owner Roman Abramovich made six … [Read More...]

    In this image released by NASA, a SpaceX Falcon 9 rocket with the … [Read More...]

    Milwaukee residents who were eager to get vaccinated have likely had … [Read More...]

    MOSCOW, April 17. /TASS/. Russia’s Soyuz MS-17 spacecraft with … [Read More...]

      About Us   |   Terms and Conditions   |   Copyright   · Copyright © 2021

    Copyright © 2021 · elegance Theme On Genesis Framework · WordPress · Log in