57 minutes wey don pass

Wia dis foto come from, PDP
Aba bye-election results for one federal parliament seat, na Nigeria main opposition PDP candidate win, di kontri election office declare.
Former Abia Gover and Senator Orji Uzor Kalu kinsman Mascot Uzor Kalu, wey lose election for Abia State don accept di result.
Di election for Aba North/South Federal Constituency inside eastern Nigeria bin happun on Saturday 27 March, 2021.
Mascot Uzor Kalu, na candidate of di kontri ruling All Progressive Congress (APC) and im lose to im main opponent Chimaobi Ebisike, of di People’s Democratic Party (PDP) for di result wey di Independent National Electoral Commission (INEC) declare.
Orji Uzor Kalu, Senate Chief Whip and di latest APC member for Abia State, Azubike Ihejirika, former Chief of Army Staff bin join oda party leaders to lead di campaign for Mascot.
Abia bye-election final result as INEC declare
Margin of lead: 6749 votes
Wia dis foto come from, I N E C
Wetin Uzor Kalu tok afta dem declare di results
Mascot Uzor Kalu, for di statement wey im release allege how hoodlums kidnap and intimidate voters during di election.
Im tok say, “Di March 27, 2021 Aba North and Aba South Federal Constituency by-election don ove and di Independent National Electoral Committee (INEC) don declare Peoples Democratic Party (PDP) winner. We dey beg our members say make dem accept dioutcome of the elections for good faith while I dey appreciate dem for making APC dey stronger for Abia.
But PDP for dia own reaction tok say di landslide victory for di North/South Federal Constituency bye-election don show say dem dey superior particularly over di All Progressives Congress (APC), not only for Abia state and di Southeast geo-political zone, but also across die nation.
“Indeed our party defeat of APC for Aba, wey be major commercial and social hub and the nerve center of di southeast, don further show Southeast as undisputed stronghold of di PDP,” Kola Ogbodiyan, National Publicity Secretary of PDP tok for statement.
Leave a Reply